Morocco vs DR Congo highlights: Silas late goal help DR Congo draw level wit di Atlas Lions

Morocco vs DR Congo highlights: Silas late goal help DR Congo draw level wit di Atlas Lions

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Morocco vs DR Congo

21 January 2024

Morocco and DR Congo share points for dia second group game for di 2023 Africa Cup of Nations (Afcon).

Di match wey happun for di San Pedro Stadium on Sunday see plenti action between di Atlas Lions and di Les Leopards.

Achraf Hakimi early goal for di 6th minute give di best team for Africa di lead.

Morocco dominate di game but DR Congo too no give dem space. Di pressure from DR Congo later earn dem penalty for di late minutes of di first half but dem miss dia penalty kick wey Cedric Bakambu play.

Second half start wit more intense action and pressure, but e go in favour of DR Congo as dem get dia equaliser for di 77th minute thru Silas.

Morocco na di only Group F team wey win dia first game – dem beat Tanzania 3-0-now dem don draw wit DR Congo.

Group F still dey open until di last Group match.

Match highlights

Second Half

Full Time Morocco 1-1 DR Congo

90+9 Referee Peter Kamaku don blow. whistle to end di match.

90+4 Di game don stop now as Lionel Mpasi-Nzau DR Congo get knock and di physio dey treat am.

Ayoub El Kaabi (Morocco) misses a good chance to score. A perfect cross into the box finds Ayoub El Kaabi (Morocco) who rises for a header, but he sends the ball well over the bar.

Fiston Mayele (D.R. Congo) runs with the ball towards the keeper and pulls the trigger from close range, but Bono anticipates his intention and makes an amazing save to stop the shot from going into the top left corner.

90+3′ Ayoub El Kaabi of Morocco miss one good chance to score. A perfect cross into di box find Ayoub El Kaabi of Morocco wey jump to head di ball, but im sends di ball well over di bar.

90+1′ Fiston Mayele of DR Congo runs wit di ball towards di keeper and shoot from close range, but Bono read im plan, goalkeeper Bono stop di shot from going into di top left corner.

90′ Referee add 7 minutes

89′ Charles Pickel DR. Congo dey down wit injury and di referee stops play for medical treatment.

87′ Amine Adli of Morocco don collect yellow card shows him a yellow card for bad tackle.

85′ Amine Adli of Morocco clip one inviting cross into di box, but nobodi dey beta position to get to di end of it. Di ball don comot from di pitch and na goal kick for DR Congo.

84′ Chancel Mbemba of DR Congo need medical treatment, so di referee stop play and signals for di physio to come inside di pitch.

83′ Gedeon Kalulu of D.R. Congo sends one long crossfield pass , e dey use eye find one of im teammates, but im effort comes to nothing and dem lose possession.

82′ Ayoub El Kaabi don join di action as a substitute, e replace Azzedine Ounahi.

81′ Double Substitution for Morocco, Youssef En Nesyri don comot and Walid Regragui give di last tactical orders to Amine Harit wey replace am.

79′ Half-chance! Samuel Moutoussamy of DR Congo plays one pass into di box, but Bono reacts well to snuff out di attack.

77′ GOAL! Silas don score di equalizer for D.R. Congo as e bury di ball for back of di net!

74′ DR. Congo corner kick dey blocked by Bono of Morocco.

73′ Subsitution for Morocco, Amine Adli don comot for Hakim Ziyech.

70′ Meschack Elia of D.R. Congo escape without any punishment from di referee after im use too much force to foul im opponent.

66′ Meschack Elia of DR Congo send over one cross from di side into di penalty area ito find im teammates, but im fails and di opportunity just waste.

64′ Selim Amallah too don play finish nd Bilal El Khannouss replace am

63 Double Substitution for Morocco. Sofiane Boufal don comot from di pitch and na Abde Ezzalzouli replace am.

62′ Gael Kakuta of DR Congo nearly create one chance, but im attempt to pick out a teammate wit through ball no pay off..

61’One attempted cross from Chancel Mbemba of DR Congo dey cleared.

59′ Achraf Hakimi of Morocco of slip past one challenge, but im no fit give a low pass into di path of one of im teammates.

58′ Chancel Mbemba of DR. Congo produce one long-range pass.

55′ Achraf Hakimi of Morocco pull di jersey of one of di opposition players and Peter blows im whistle for a foul.

53′ Anoda substitution for DR Congo, Cedric Bakambu play time don end and Silas enta for am.

53′ Substitution for DR Congo, Theo Bongonda don comot and Meschack Elia replace am.

52′ Cedric Bakambu of D.R. Congo cracks a first-time shot from inside di box, but e fly comot off di left post.

51′ Romain Saiss of Morocco and Mohamed Chibi perform one quick tiki-taka to get past two defenders and den continue di move along di side line.

50′ DR Congo play di corner wey threaten di defnce of Morocco but nothing come out.

49′ Di referee and one of his assistants signal for a corner kick to D.R. Congo.

48′ DR Congo get chance to score from a corner kick.

48′ Gael Kakuta of DR Congo try to create chance, but puts too much weight on im pass.

46′ Second half don start as Referee signaleit im whistle.

First Half

45+11 Referee Peter Kamaku don blow whistle to singnal di end of first half.

45+7′ A player from Morocco commits one rough challenge. Referee blows for foul to keeps di game under control.

45+6′ Chancel Mbemba of DR. Congo delivers a fine cross into di penalty area, but Morocco defence clear am.

45+5′ Hakim Ziyech of Morocco and Nayef Aguerd combine well wit some one-touch passing, dem dey build up to attack small small.

45+3 Morocco goalkeeper Bonou just dey rest since, DR Congo neva disturb am

45′ Referee add 11 additional min.

44′ Hakim Ziyech of Morocco collect yellow card sake of foul.

42′ MISS! DR Congo miss dia penalty kick wey Cedric Bakambu play.

40′ Selim Amallah Morocco collect yellow card as VAR review say im hand touch di ball for di defence area.

39′ Afta a long wait and VAR review Referee Peter Kamaku give Amallah of Morocco yellow card and award Penalty to DR Congo

Henoc Inonga (D.R. Congo) is lying on the ground after being tackled and the physio comes onto the pitch to give him medical treatment.

34′ Henoc Inonga of D.R. Congo dey ask for some medical attention, be like say im dey feel painful. Di extent of im injury neva dey clear.

30′ Morocco defence block di corner from DR Congo, noting comeout from am.

30′ Morocco defence block di free kick from long range, wey DR Congo play.

29′ Di referee blow whistle as Achraf Hakimi of Morocco bin dey too aggressive on one challenge im make.

26′ Di free kick from long range wey DR Congo play go wide as im overhit di ball. Goal kick for Morocco.

25′ Peter Kamaku blow im whistle afta Selim Amallah of Morocco kick im opponent legs instead of di ball.

23′ One pass from di defence find Hakim Ziyech of Morocco in space, im fire shot sharp sharp from long range wey go wide off di left post.

22′ Youssef En Nesyri of Morocco dey beta position to meet a cross, im head di ball towards di middle of di goal, but di goalkeeper reacts well to stop di effort.

18′ Youssef En Nesyri of Morocco jump high to head one nice cross towards di roof of fi net. Unfortunately for am, im close-range effort no fast reach and Lionel Mpasi-Nzau comfortable save am.

15′ Romain Saiss of Morocco commits rough foul. Referee stops di game.

15′ Achraf Hakimi of Morocco sends a long ball in, but Lionel Mpasi-Nzau comfortably gada di ball.

13′ Selim Amallah of Morocco bin play di ball wit too much force wit im tackle and Referee Peter Kamaku interrupted di game to signal free kick.

13′ Chancel Mbemba of DR Congo get di ball from di corner kick, e shoot am from di edge of di box but di ball go wide of di left post.

12′ Referee Peter Kamaku points to di corner flag and DR Congo gopl ay corner.

12′ Theo Bongonda of DR Congo fire dia first shot from di edge of di box, but Morocco defender block im effort.

10’Achraf Hakimi of Morocco play di throw-in sharp sharp so dat im teammates fit outnumber di defenders for di penalty box.

7′ GOAL! Achraf Hakimi of Morocco controls di ball from di corner kick and put am past di helpless goalkeeper.

4′ Morocco get corner kick.

2′ Early goal attempt from Morocco as Ziyech give pass to En-Nesyri wey head di ball toward di top post. Lionel Mpasi-Nzau show im brilliant reflexes and pulls off a glorious save to stop di ball from hitting di net.

1′ Referee Peter Kamaku from Kenya don blow whistle, match don start.

Both teams don file out for dia National anthems, match go soon start.

Line ups

Morocco starting XI: Yasine Bounou, Achraf Hakimi, Sofyan Amrabat, Nayef Aguerd, Ghanem Saiss, Hakim Ziyach, Azz-Eddine Ounahi, Selim Amallah,Youssef En-Nesyri, Sofiane Boufal, Mohamed Chibi

DR Congo starting XI: Lionel Mpasi, Henock Inonga, Samuel Moutoussamy, Theo Bongonda, Gael Kakuta, Cedric Bakambu, Charles Pickel, Yoane Wissa, Chancel Mbemba, Gedeon Kalulu, Fuka Masuaku

Skip Twitter postAllow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Accept and kontinuWarning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post

Source link : https://www.bbc.com/pidgin/articles/ck56j78686do.amp

Author :

Publish date : 2024-01-21 03:00:00

Copyright for syndicated content belongs to the linked Source.

Exit mobile version